1st Chronicles Chapter 8
Di Family Tree of King Saul of Benjamin
- Benjamin born Bela, wey be hin firstborn, Ashbel nahin be hin second, Aharahnahin be dithird,
- Nohah na di fourth, and Rapha na di fifth.
- Bela sons na: Addar, Gera, and Abihu,
- Abishua, Naaman, and Ahoah,
- Gera, Shephuphan, plus Huram.
- Dis na di sons of Ehud wey be leaders of di families wey dey live for Geba. Dem pursue dem komot, and dem go stay for Manahath:
- Ehud sons na: Naaman, Ahijah, and Gera wey lead dem komot. Geranahin be di papa of Uzzah plus Ahihud.
- Dem born sons for Shaharaim for inside Moab afta he leave hin wives Hushim plus Baara.
- Hin wife Hodesh born Jobab, Zibia, Mesha, Malkam,
- Jeuz, Sakia, plus Mirmah. Na hin sons be dis; dem be family leaders.
- Hin wife Hushim born Abitub plus Elpaal.
- Na dis be di sons of Elpaal: Eber, Misham, Shemed [wey build Ono plus Lod, wit di towns wey dey around am],
- And Beriah plus Shema wey be leaders of di families wey dey stay for Aijalon, and dem pursue di pipo wey dey live for Gath.
- Ahio, Shashak, Jeremoth,
- Zebadiah, Arad, Eder,
- Michael, Ishpah, plus Joha na di sons of Beriah.
- Zebadiah, Meshullam, Hizki, Heber,
- Ishmerai, Izliah, and Jobab na di sons of Elpaal.
- Even Jakim, Zikri, Zabdi,
- Elienai, Zillethai, and Eliel,
- Adaiah, Beraiah, plus Shimrath na di sons of Shimei.
- And Ishpan, Eber, Eliel,
- Abdon, Zikri, and Hanan,
- Hananiah, Elam, plus Anthothijah,
- Iphdeiah, plus Penuel na di sons of Shashak.
- And Shamsherai, Shechariah, Athaliah,
- Jaareshiah, Elijah, and Zikri na di sons of Jeroham.
- Na dis na di heads of dia papa house based-on dia generations, and dem be chiefs—wey stay for Jerusalem.
- Gibeonpapastay for Gibeon; hin wife name na Maacah.
- Hin firstborn son na Abdon, follow by Zur, Kish, Baal,Nadab,
- Gedor, Ahio, Zeker, plus Mikloth.
- Mikloth nahin born Shimeah. And dem stay near dia family-pipo for Jerusalem.
- Ner nahin be di papa of Kish, and Kish nahin be di papa of Saul. Saul nahin born Jonathan, Malki-Shua, Abinadab, plus Eshbaal.
- Dis na di son of Jonathan: Meribbaal. And Meribbaal born Micah.
- Dis na di sons of Micah: Pithon, Melech, Tarea, plus Ahaz.
- Ahaz born Jehoaddah, and Jehoaddah nahin be di papa of Alemeth, Azmaveth, plus Zimri. Zimri nahin born Moza,
- and Moza nahin born Binea. Hin son na Raphah, Eleasah, plus hin son Azel.
- Azel get six sons: Azrikam wey be hin firstborn,follow by Ishmael, Sheariah,Obadiah, plus Hanan. Na all dis be di sons of Azel.
- Dis na di sons of hin broda Eshek: Ulam nahin be hin firstborn, Jeush second, and Eliphelet na di third born.
- Di sons of Ulam na strong men wey sabi shoot arrow well-well.Dem get plenty sons plus grandsons, all of dem na 150. And na all dis ones be di sons of Benjamin.