-
Genesis Chapter 1
Di Starting 1. For di beginning, Baba-God make di heavens plus di earth, Di First Day: Light 2. Di earth con dey anyhow, everi where empty kpatakpata, and darkness cover on top of di deep water. So Baba-God Spirit move on top of di water. 3. Naso Baba-God tok sey, “Make light dey!” And light just show-face. 4. Baba-God see sey di light make-sense, so Baba-God separate di light from di darkness. 5. He call di light “Day,” con call di darkness, “Night.” And evening plus morning pass—naso di first day be. Di Second Day: High-sky 6. Baba-God con tok sey, “Make high-sky show face from di water, and make…
-
Genesis Chapter 2
Baba-God Rest For Di Seventh Day Adam plus Eve Inside Di Garden 4. Na di generations of di heavens plus di earth be dis—wen Baba-God make dem, for di day wen Baba-God di Oga make di heavens plus di earth, 5. plus everi plant wey dey grow for field, before e show for inside di earth, plus everi herb for di land before dem grow: dat time, Baba-God neva make rain fall for di earth, and no pesin dey to dig di ground to plant. 6. But one cloud form from di earth, con water di whole face of di ground. 7. And Baba-God form man from di dust wey…