1st Corinthians Chapter 13
Love
- If I tok wit tongues of men and angels, but I no get love, I be like bell wey dey ring, or cymbal wey dey make noise.
- If I get di gift of prophecy, I sabi understand deep- matas, and I know everi-everi, and if I get faith wey fit move mountains, but I no get love, I be notin.
- If I give everitin wey I get to poor pipo, and I sacrifice my body, but I no get love, wetin I gain? Notin!
- Love na patience, love dey kind. E no dey jealous, e no dey make-mouth, e no dey carry- shoulder.
- E no dey behave anyhow, e no dey selfish, e no dey quick provoke, e no dey carry evil for mind.
- Love no dey happy for evil mata, but e dey jolly wit truth.
- Love dey bear everitin, e always dey trust everitin, e always dey hope, and endure everitin.
- Prophecy, speaking in tongues, and knowledge fit fade, but love no go ever fail.
- We only know small part, and we dey prophesy wit di small part.
- But wen time reach for di perfect tins, wetin no dey perfect go disappear.
- Wen I be small pikin, I tok like small pikin, I tink like small pikin, and I reason like small pikin. But wen I turn to man, I put small pikin tins for one corner.
- Now we dey look dark mirror, but dat time we go see face to face. Now I know only small part; but dat time, I go know fully, even as Baba-God fully know me.
- Na three tins go last forever: faith, hope plus love. But di one wey great pass na love.