About Di Scata-scata For Inside Church
- Brodas, I no fit reason wit una as spiritual pipo, but as world-pipo, as small pikin for Christ mata.
- I bin give una milk, no be strong food. Una neva ready. Even now, una neva still ready.
- Una still dey reason world mata. As una still dey jealous unasef, and dey kwanta unasef, abi una no be world pipo? Abi una no dey behave like ordinary men?
- If one pesin tok sey, “I dey follow Paul,” and anoda pesin tok sey, “I dey follow Apollos,” no be ordinary men una con dey behave like?
- Who be Apollos sef? And who be Paul? Dem just be servants wey make una believe, just as Baba-God take give everi-pesin hin job.
- I plant seed, and Apollos water am, but Baba-God nahin make am grow.
- So pesin wey plant, and pesin wey water am—no be anytin, but only Baba-God wey dey make tins grow—nahin be everitin.
- Di man wey plant, and di man wey water am—na one, and dem go get dia blessings based-on dia hustle.
- All of us dey work togeda for Baba-God; and una be Baba-God farm. Una be Baba-God building.
- Wit di grace wey Baba-God don give me, I don build foundation as I be professional builder, and anoda pesin dey build house on top. But make everi- pesin dey careful di way he dey build.
- No-pesin fit lay any foundation apart from di one wey don already dey—wey be Jesus Christ.
- Any man fit use—gold, silver, stone wey cost well-well, wood, grass or block—take build on top of dis foundation,
- di day go show as everi- pesin work be, becos na faya go show am. Na faya go test everi- pesin work—which kain work e true-true be.
- If wetin he build survive, he go receive blessings.
- If wetin he build burn, he go suffer di loss; hinsef go get salvation, but like pesin wey pass tru faya.
- Abi you no know sey you be Baba-God church, and Baba-God Spirit dey stay for inside you?
- If any-pesin scata Baba-God church, Baba-God go scata am; Baba-God church dey holy, and na you be dat church.
- Make una no whyne unasef, if any one of una tink sey he get-sense based-on di level of dis world, make he behave like “mumu” so dat he go fit learn.
- Di wisdom of dis world be like mumu tin for Baba-God eyes. As dem write am sey: “Baba-God dey catch wise pipo wey tink sey dem smart”;
- And again, “Baba-God know sey wise man dey waste hin time dey reason.”
- So make una no dey make-mouth about men! Everitin belong to una,
- whether Paul or Apollos or Cephas or di world, or life, or death, or tins wey dey now, or tins wey go come—na una get all of dem,
- you belong to Christ, and Christ belong to Baba-God.
Post Views: 46