1st Samuel Chapter 24
David No Gree Kill Saul
- Afta Saul come back from pursuing di Philistines, dem con tell am sey, “David dey for inside di desert of Engedi.”
- So Saul carry three thousand best sojas from all Israel, and dem komot go fyne David and hin men near di east side of Wild Goat Rocks.
- He reach one sheep-house wey dey for road; Saul con see one rock, so he enta inside di rock go chill. David and hin men con dey hide for inside di same rock sef—but far-far for di back side.
- Di men tok sey, “Dis na di day wey Baba-God tok about, wen he tell you sey, ‘I go put your enemy for your hand—for you to deal wit am as you like.’ ” Naso David crawl go cut small part of Saul cloth and no pesin notice am.
- Lata-lata, David mind con dey judge am becos he cut small part of Saul cloth.
- He tell hin men sey, “Baba-God forbid make I do dis kain tin to my oga—pesin wey Baba-God anoint, or carry my hand against am, becos na pesin wey Baba-God don anoint.”
- David stop hin men wit dis words, and he no gree let dem attack Saul. So Saul komot from inside di rock, con go hin way.
- Naso David komot from inside di rock, con halla Saul, “My oga di king!” Wen Saul look hin back, David bow down wit hin face for ground.
- He tell Saul sey, “Why you dey listen to men wey dey tok sey David wan surely wound you’?
- Today you don see wit your own eyes how Baba-God don put you for my hands inside di rock. Some pipo ginger me to kill you, but I no gree kill you; I tok sey, “I no go carry my hand against my oga, becos na pesin wey Baba-God anoint.’
- See, Baba, look di pieces of you cloth for my hand! I cut small part of your cloth komot, but I no gree kill you. Now I wan make you know sey I neva do any bad tin, or change-am-for you. I neva do wrong tin to you, but you dey hunt me to kill me.
- Make Baba-God judge between you and me. And make Baba-God revenge di bad tins wey you don do me, but my hand no go touch you.
- As dem dey tok dis old proverb, ‘Na only evil men dey do evil tins.’ And I no go do you bad.
- “Who di king of Israel come out against? Who you dey pursue? Abi na dead dog? Abi na fly?
- Make Baba-God be awa judge, con decide who dey wrong between us. Make he look di mata, con defend me and save me from you.”
- Wen David tok dis tins finish, Saul con ask am, “Na your voice be dat, David my pikin?” Naso he con dey cry out.
- He con tell David sey, “You get clean-heart pass me, you don treat me well, but I no treat you well.
- You don tell me about di beta tin wey you don for me just now; Baba-God put my life for your hand but you no gree kill me.
- Wen pesin see hin enemy, abi e go let am go wit-out wounding am? Make Baba-God pay you well becos of di way you do me today.
- I know sey you go surely be king and di kingdom of Israel go stand for your hands.
- Now swear to me wit Baba-God sey you no go cut my pikin-pikin-pikin, or komot my name from my papa family.”
- So David swear to Saul. Naso Saul go back to hin house, but David and hin men go back to di place wey dem dey hide.