2nd Chronicles Chapter 28

Abeg share

Ahaz As King of Judah

  1. Ahaz na twenty years wen he climb di king-chair, and he be king for sixteen years for Jerusalem. He no do di correct tins for Baba-God eyes, he no gree follow di ways of hin ancestor David.
  2. He follow di ways of di kings of Israel; he still make images of Baal—wey  dem build.
  3. He give sacrifices for bottom-of-di-mountain wey dem dey call Ben-Hinnom. Evensef, he sacrifice hin son for faya; evil sin wey di nations wey Baba-God pursue from front of di pipo of Israel dey do.
  4. He give sacrifices, con burn incense for di shrines of di idols, for di hills, and for under everi green tree.

Syria plus Israel Win Judah

5. So Baba-God hin Oga carry am put for di hand of di king of Syria. Di Syrians win am, and dem carry plenty pipo as prisoners go Damascus. Baba-God still carry am put for di hand of di king of Israel, wey win am, con wound and kill hin army well-well.

6. For just one day, King Pekah wey be di son of Remaliah of Israel kill 120,000 strong sojas for Judah, becos dem fashi Baba-God of dia papa-papa-papa.

7. Zikri, wey be strong man from Ephraim, kill Maaseiah wey be di king son, and Azrikam wey dey in charge of di palace, plus Elkanah di king second-in- command.

8. Di pipo of Israel carry dia brodas (family-pipo) as prisoners; 200,000 wives, sons, and daughters. Dem still carry plenty-plenty properties go back to Samaria.

Israel Release Di Prisoners of War

9. Oded wey be Baba-God prophet, dey for there. He go meet di army as dem reach Samaria, he con tell dem sey: “See, becos Baba-God of una ancestors dey vex for Judah, nahin make am carry dem put for una hand. And una don use vex take kill dem well-well sote Baba-God notice am.

10. And now una dey plan to turn di pipo to slaves, di pipo of Judah plus Jerusalem. Abi even you sef no dey commit sin against Baba-God?

11. Now make una listen to me! Send back di prisoners wey una catch from una brodas, becos Baba-God dey vex for una well-well!”

12. So some of di pipo of Ephraim, family leaders; Azariah wey be di son of Jehochanan, Berechiah wey be di son of Meshillemoth, and Jechizkiah wey be di son of Shallum, plus Amasa wey be di son of Hadla—con face those pipo wey dey come back from war.

13. Dem tell dem sey, “Make una no bring those pipo wey una catch as prisoners come here! Abi una dey plan to add more sins to di sin and bad tins wey we don do for Baba-God eyes? Awa sins don already burku and Baba-God dey vex for Israel.”

14. So di sojas release di prisoners and dia properties wey dem collect for front of di officials plus di whole pipo wey gada.

15. Di men wey dem call dia names just now, carry di prisoners, con fyne  clothes for those wey dey naked among dem—from di properties wey di men of Israel bin obtain from dem. So dem give di prisoners cloth, dem still give dem sandals, con give dem food plus drinks make dem chop, and dem give dem ororo to rub for dia skin. Dem use donkeys take carry di ones wey no fit waka. Dem con carry Dem go back to dia brodas for Jericho, di city of palm trees. Dem con go back to Samaria.

Assyria No Gree Epp Judah

16. Around dat time, King Ahaz con ask di king of Assyria for epp.

17. Di pipo of Edom bin take-over Judah again, con win dem, and even carry pipo komot.

18. Di Philistines bin attack di cities of Judah for di lowland, and di south. Dem take-over Beth-shemesh con settle down for there—and even; Aijalon, Gederoth, Shocho plus di villages wey dey around dem; plus Timnah and Gimzo—and dia villages wey dey around dem.

19. Baba-God fall Judah hand, becos of King Ahaz of Israel, becos he ginger Judah to do bad-bad-tins and he no follow Baba-God wit hin heart.

20. King Tiglath-pileser of Assyria come, but he cos more wahala for am—but he no epp am.

21. Ahaz gada some of di beta-beta-tins from Baba-God house, di palace, and from di princes, and he carry dem give di king of Assyria, but dat one no still epp am.

Ahaz Worship Idols

22. Wen wahala show-face for King Ahaz, na dat time he even turn more-more komot from Baba-God.

23. He give sacrifices to di gods of Damascus wey bin win am. He reason sey, “Since di gods of di kings of Syria epp dem, I go sacrifice to dem so dat dem go epp me.” But dem fall hin hand, wit all Israel.

24. Ahaz gada di properties for inside Baba-God house and he cut dem to pieces. He close di doors of Baba-God house, and he build altars for everi street corner for inside Jerusalem.

25. For  everi  city  tru-out Judah, he set up shrines for idols, to give sacrifices to

oda gods. Naso he take make Baba-God vex—he make di Oga of hin ancestors vex.

     Hezekiah Take Ahaz Position For Judah

26. As for di rest tins wey happun wen Ahaz be king, even all di tins wey he do, from starting to ending—dem write dem for di Book of di Kings of Judah and Israel.

27. Ahaz die las-las, and dem bury am for di City of David; dem no bury am for inside di burial ground of di kings of Israel. So hin pikin Hezekiah, take hin place as king.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *