Paul Defend Hin Work
- Wit di softness and jeje of Christ, me, Paul—dey beg una. I dey lowkey wen I dey wit una, but I get full-mind wen I no dey around una!
- So, I dey beg una now, so dat wen I land, I no go show mysef wit full-mind against some pipo wey tink sey we dey live based-on di world level.
- Even though we dey live for di world, we no dey fight war as world pipo take dey fight.
- Di weapons wey we dey use dey fight war—no be di weapons of dis world. Instead, dem be ogbonge tru Baba-God—to bring down any strong- house.
- We dey break down any argument, and everi high tin wey dey feel-big against di good news of Baba-God. We dey seize everi reasoning to obey Christ.
- And once una don dey obey fully, we go dey ready to punish everi disobedience.
- You dey look tins based- on how e be for outside? If any- pesin dey convinced for hinsef sey he belong to Christ, make he reason di mata again, sey we belong to Christ as hinsef belong.
- Even if I dey make- mouth about di pawa wey Baba-God give us to teach and not to drag una go down, shame no go catch me.
- I no wan make e be like sey I dey make fear catch una wit my letters.
- Some pipo tok sey, “Hin letters get weight plus pawa, but he no get levels if you see am, and wetin he dey tok no make-sense.”
- Those kain pipo suppose know sey wetin we be inside awa letter wen we no dey around, na di same way we be wen we dey around.
- We no fit put awasef for di same level wit some pipo wey dey praise demsef. Wen dem use demsef measure demsef, con compare demsef wit demsef, dem no get-sense.
- We no go make-mouth pass awasef, but we go only make- mouth for di area wey Baba-God don give us, and awa work wit una sef join.
- So, we no dey do pass awasef [as if we no get di authority to come meet una], na una we carry di good news of Christ come meet.
- No be sey we dey cross awa boundary—con dey use oda pipo hustle dey make-mouth. Awa hope be sey, make una faith kontinu to dey grow, so dat di areas wey we dey work wit una go grow wella.
- So dat we go fit preach Baba-God word for oda far-far areas from here, where no-pesin dey preach. We no wan make- mouth wit di work wey anoda man don already do for hin area.
- But, “Any-pesin wey wan make-mouth, make e make- mouth wit Baba-God.”
- No be di pesin wey dey praise hinsef nahin Baba-God go confam, but na di pesin wey Baba-God praise.
Post Views: 56