2nd Timothy
-
2nd Timothy Chapter 4
1. Na beg I dey beg you for front of Baba-God, and Oga Jesus Christ—wey go judge di living plus di dead, wen he go show wit hin kingdom: 2. Preach di word; dey ready any time. Convince, correct, and preach wit all patience plus teaching. 3. Time go reach wen pipo no go dey follow good teaching again; instead dem go follow dia selfish mind—dem go gada plenty teachers, to tell dem di tins wey dia ears wey dey scratch dem wan hear. 4. and dem go turn dia ears komot from di truth, con turn dia ears to tori. 5. But dey at alert for everitin, endure suffer-head,…
-
2nd Timothy Chapter 3
Evil For Di Last Days 1. But know dis tin: Hard times go dey for di last days. 2. Pipo go love only demsef, dem go love moni, dem go dey make-mouth, dey carry shoulder, dem go down-grade Baba-God, dem go disobey dia mama and papa, ungrateful, wicked, 3. dem go fashi love, dem go fashi forgiveness, dem go dey bad-mouth odas, dem no go fit control demsef, dem go bad well- well, and dem go hate any beta tins. 4. Dem go betray dia padi, dem go dey do anyow, dem go dey feel-big, dem go love flexing pass as dem take love Baba-God. 5. Dem go dey form…
-
2nd Timothy Chapter 2
Di Christain Fight 1. You Timothy my son, make you dey strong inside di grace wey dey for Christ Jesus. 2. Make faithful men handle di truth wey you don hear me tok for front of plenty pipo—men wey go sabi teach oda pipo sef. 3. So you must endure suffer-head as beta soja of Christ Jesus. 4. Soja wey dey fight war no dey run civilian package—instead, he go try to make hin oga happy. 5. Naso e be sef, any-pesin wey wan do sport, no go fit carry di first prize—unless he obey di rules. 6. Di farmer wey dey hustle hard pass—nahin suppose be di first to…