2nd Samuel Chapter 22
David Song of Praise
- David sing to Baba-God di words of hin song wen Baba-God save am from di hands of all hin enemies and from di hand of Saul.
- He tok sey, “Baba-God na my Rock, my strong-house, and nahin dey save me;
- My God na my rock wey I dey trust; nahin be my shield and di horn wey dey save me, na my tall-house, nahin I dey hide my head put, and nahin be my savior; you dey save me from fight-fight.
- I go call to Baba-God wey get levels to receive my praise, naso I go free from my enemies.
- Di waves of death surround me; di plenty-water of wicked men make me fear.
- Di ropes of grave tie me round; di trap of death set trap for me.
- So I call Chineke [Baba-God] from inside my wahala, I cry to Olodumare (Baba-God). From hin holy place nahin he take hear my voice, and my cry enta hin ears.
- Naso di earth shake, con move, di foundation of heavens shake, e shake beos Baba-God dey vex.
- Smoke pour come out from hin nose-pipe, hot faya spit from hin mouth. Red charcoal burn from am.
- He divide di heavens, con come down and dark couds dey for under hin leg.
- He ride di cherubim, con fly, he fly on top of di feathers of di breeze.
- He make darkness di canopy wey round am—dark water, plus thick rain clouds of di sky.
- Ogbonge light shine round am, and hot coal burn come out.
- Baba-God shout like thunder from heaven—di voice of di Most High sound.
- He shoot arrows, con scata hin enemies; he use di flash of lightning take cos katakata for dem.
- As Baba-God yarn, as hin breath sound, bottom of di big-river open, and di foundations of di earth open.
- “He reach down from up-up, con hold me; he drag me komot from plenty-water.
- He save me from my enemie wey get pawa well-well, and from di pipo wey get badbelle for me, becos dem too strong pass me.
- Dem face me on di day of my wahala, but na Baba-God support me.
- He carry me come out to big place, he save me becos he like me well-well.
- Baba-God don bless me based-on my pure heart, he pay me based-on my clean-hand.
- Becos I don keep di ways of Bab-God; I neva do evil by turning away from my God.
- All di laws dey for my front, and I neva turn komot from Baba-God words.
- I no get error for Baba-God front, and I don komot hand from my sin.
- So Baba-God don pay me based-on my pure heart; based-on my clean-hand for hin eyes.
- You dey sorry-for pipo wey dey sorry-for pesin, and your way straight for pipo wey dia way straight.
- You dey show sey you pure—to pipo wey pure; but you dey show sef you sharp—for pipo wey dey do korni-korni [pipo wey dia way don bend].
- You dey save humble pipo; but your eyes dey on pipo wey dey feel-big—so dat you go fall dia hand.
- Oh Baba-God, na you be my lamp; and Baba-God go shine light for my darkness.
- Wit your epp I fit carry-go fight sojas; wit my God I fit jump fence.
- As for Baba-God, hin way dey perfect; Baba-God word na confam; Baba-God na shield [odieshi] for those wey dey trust am.
- Who be God apart from Baba-God? Who apart from awa God be di Rock?
- Na Baba-God dey give me pawa like weapon, and nahin dey make my way perfect.
- He dey make my leg be like di leg of deer; and he dey set me put for high place.
- He dey train my hand how to sabi fight war; my hand fit bend bow wey be bronze.
- And you don give me di shield wey dey save me; your jeje way don make me be ogbonge pesin.
- You dey give me wide space to put my leg, so dat my ankles no go dror-fall.
- “I don pursue my enemies and I don scata dem; and I no gree turn back again until all of dem scata kpatakpata.
- I scata dem finish, and dem no fit stand up again; dem fall under my legs.
- You give me pawa like weapon for war; you don make all di pipo wey dey raise against me—bow under me.
- And you don give me di necks of my enemies, so dat I scata all those wey hate me.
- Dem look, but no pesin dey to save dem; dem even look Baba-God, but he no gree ansa dem.
- I beat dem sote dem con smooth like dust for ground; I march dem like portor-portor [mud] for street, and I scata dem for everi where [abroad].
- “You don save me from di attack of my pipo; you don keep me as di head of di nations. Pipo wey I no sabi before go serve me.
- Foreigners go give demsef to me, dem dey obey me wen dem hear me.
- Dem dey lose heart, and dem dey shake as dem dey come from dia strong-house.
- “Baba-God dey alive! Blessing for my Rock! And make Baba-God levels high, Di Rock wey dey save me!
- Nahin be di God wey dey revenge for me, and nahin dey put pipo under me;
- Nahin dey free me from my enemies; and he dey carry me up from di pipo wey dey raise up against me; you don save me from di man wey like oppression and blood.
- So I go tell you nagode [give tanks to Baba-God], oh Baba-God, among di nations, and I go sing praises for your name.
- Nahin be di tall-house wey dey save Hin king, and he dey show mercy to di pesin wey He anoint, he dey show mercy to David and hin pikin-pikin-pikin forever.