Job Chapter 34
Elihu Confam Baba-God Justice
- Elihu ansa, con tok sey,
- “Hear my words, oh una wey be wise men, and make una listen to me, una wey sabi sometin.
- Becos ears dey judge word, just as mouth take dey taste meat.
- So make we understand for awasef wetin dey right; make we learn wetin dey good.
- Becos Job bin tok sey, “I get clean-heart but Baba-God don carry my justice.
- I dey innocent, but dem dey call me lie-lie. My wound no get cure, even though I neva commit any sin.’
- Which man be like Job wey dey drink disgrace like water?
- Wey dey waka wit sinners, and dey waka wit wicked men.
- He bin tok sey, ‘Man no go gain anytin if he put hin happiness on Baba-God.”
- So make una listen to me, una wey be men of understanding, Baba-God far well-well from wickedness, and Baba-God Almighty far from sin—sote he no fit commit sin.
- He go pay man based-on wetin man do. He dey handle pipo di way dem be [and by wetin dem dey do].
- Yes, surely Baba-God no go do wicked tin, and di Almighty no go turn judgement.
- Who put am in charge of di earth? Who make di ruler of di whole world?
- If he zero hin mind to do am, if to sey Baba-God collect hin Spirit back, con collect hin breath,
- all flesh go kpeme togeda, and man go turn to dust again.
- If you get understanding now, hear dis tok; listen to di voice of my words.
- Abi Baba-God fit rule if he hate justice? Abi you go condemn di Almighty judge?
- Abi e make-sense for pesin to tell king sey, “You be wicked pesin? And to princes—‘You be evil pesin?’
- Tokless of di pesin wey no-send prince, and wey no look sey bigman different from poor man? Becos na Baba-God make dem wit hin hands.
- All of dem go kpeme in one minute, and dem go dey shake for midnight, dem go komot from dis life; strong men go die wit no human being hand wey kill dem.
- Becos Baba-God eyes dey on di way of man, and he dey see everi where man dey go.
- E no get any darkness or any place wey dark well-well—where bad-bad pipo fit hide demsef.
- Baba-God no need to reason man pass as he be—to make am face judgement wit Baba-God [Baba-God no need to set time for judgement].
- E go break plenty-plenty strong men wey dem no fit count—to pieces, con put oda pipo for dia position.
- So he know dia works, and he dey turn dem for night, so dat dem go scata.
- He dey nack dem as wicked men for front of everi pesin,
- becos dem turn back from am, and dem no gree reason any of hin ways;
- Sote dem make poor pipo cry reach where Baba-God dey, and he hear di cry of pipo wey dey feel pain.
- Wen Baba-God choose to dey quiet, who fit change-am-for am? And who fit see am wen he hide hin face? Whether na against nation or against one single man.
- He dey stop bad pipo from ruling so dat dem no go be trap for di pipo.
- “Job, you don confess your sins to Baba-God, con promise sey you no go do dem again;
- Teach me di tins wey I no fit see , if I don do any bad-bad-tin—I no go do am again”
- Since you no gree for wetin Baba-God want, abi you fit expect am to do wetin you want? Na you go make di decision—and no be me; so tell us wetin you tink.
- Make men wey get understanding tell me, and make wise man listen to me.
- Job don tok like olodo [like pesin wey no sabi wetin he dey tok], and wisdom no dey for hin words.
- I want make Baba-God test job wit suffer-suffer—reach di end; becos he dey tok like evil men.
- Becos he don turn komot from Baba-God—to add-join hin sins, he dey clap hin hand to insult us, and he dey tok plenty tok against Baba-God.