Proverbs Chapter 28
Good Man Get-mind Like Lion
- Badbelle pipo dey run wen no-pesin dey
pursue dem, but good pipo get-mind like
lion. - Kontri wey dey commit sin dey get plenty
rulers; but man wey get knowledge and
understanding go maintain di right tins. - Poor man wey dey oppress poor man be
like heavy rain wey dey scata farm. - Those pipo wey dey fashi di law dey cut-
cap for wicked pipo, but pipo wey dey keep
di law dey change-am-for wicked pipo. - Evil men no understand justice, but those
pipo wey dey follow Baba-God understand
everi-everi. - Poor man wit clean-hand—beta pass
bigman wey no get clean-hand. - Any-pesin wey dey keep di law—na pikin
wey get- sense, but di padi of pipo wey get
longatrot—dey disgrace dia papa. - Pesin wey dey charge high interest, and
wey dey obtain pipo—just dey gada hin
moni for anoda pesin wey go show love to
poor pipo. - Any-pesin wey fashi di law, even hin prayers na tufiakwa.
- Pesin wey carry beta pesin miss-
road—con follow bad way—hinsef go fall
inside hin own pit, but pesin wey get clean-
heart—go get beta blessings. - Bigman fit tink sey he wise for hin own
eyes, but poor man wey get understanding
dey see all hin way. - Wen good man win, pipo go happy well-
well, but wen wicked man rise, pipo dey
jakpa. - Any-pesin wey dey cover hin mistake no
go grow, but any-pesin wey accept hin
mistake, con tok sey he no go do dem
again—go receive mercy. - Blessings for di man wey dey always fear
Baba-God, but pesin wey get strong
heart—go fall enta kasala. - Like lion wey dey shout, or bear wey dey
para, naso wicked
ruler be to poor pipo. - Mumu leader dey oppress hin pipo well-
well, but pesin wey hate longatrot go live
long. - Man wey hin spirit dey disturb am becos
he shed blood—go run enta pit; and make
no-pesin epp am. - Pesin wey get clean- heart—go dey safe,
but pesin wey hin way no straight—go fall
before you know. - Pesin wey hustle for hin land—go get
plenty food, but pesin wey dey use hin life
play—go poor well-well. - Faithful man go get blessings burku, but
pesin wey hin eyes dey shuuk to make moni
sharp-sharp—no go escape punishment. - E no good make pesin dey do
partiality—but men dey do wrong tin becos
of chikini bread. - Man wey hin eyes dey shuuk wan make
sharp-sharp moni, he no dey reason sey na
poverty dey wait for am. - Pesin wey correct pesin go get more
favour las-las—pass pesin wey just dey hail
pesin wit sweet-mouth. - Any-pesin wey rob hin mama or papa con
tok sey, “No be wrong tin”—be like di padi
of pesin wey dey scata tins. - Man wey dey feel-big for hin heart—dey
cos quarrel, but any-pesin wey trust Baba-
God go prosper. - Any-pesin wey trust hin own heart na
mumu, but pesin wey dey waka wit common
sense—go dey safe. - Any-pesin wey dey give poor pipo go always get enuff, but any-pesin wey dey throway-face from poor pipo—go receive plenty curse.
- Pipo dey run go hide wen wicked pesin
get pawa, but good pipo go shine wen
wicked man kpeme.
Questions about Proverbs 28
What is Proverbs 28 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 28 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-28/
Where can I read Proverbs 28 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 28 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-28/
Which Bible book contains Proverbs 28?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 28?
The chapter identified by this reference is 28.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Hope
- Forgiveness
- Wisdom
- Money
- Guidance