Ecclesiastes Chapter 6
Life Is Not All About Di Moni
- E get one evil tin wey I don see for under di sun, and e dey common among men:
- Man wey Baba-God don give moni, respect, plus beta-beta-tins, sote he get everitin wey he want—but Baba-God no give am pawa to chop from wetin he get, but na stranger con dey chop wetin he get. Dis one sef no-make-sense (na vanity) and evil disease.
- If man get hundred pikins, and he live for many years, wit long life; no mata how long he live, if he no enjoy hin moni plus beta life—and dem no do beta burial for am; even pikin wey die for hin mama belle beta pass dat kain man.
- Becos he come in vain, and he go komot wit darkness, and hin name go cover wit darkness.
- Even though he no see di sun or know anytin about life, dat kain pikin still get peace pass dat man.
- Yes, even though he live for one thousand years—two times, but he no fit enjoy hin moni—abi all of dem no dey go di same place (grave)?
- All di work wey man dey work na for hin mouth, but man no dey belleful.
- How wise man use take beta pass mumu man. And wetin poor man gain if he sabi live among pipo (becos poverty sef no be di secret of happiness)?
- E beta make you enjoy wetin your eyes fit see, dan make you dey put-mind for wetin you neva get. Dis kain tin sef no make sense (na vanity)—and e be like sey pesin dey try to catch breeze.
- Everitin wey dey happun now na plan wey don arrange since tey-tey. Man no sey he be man, and he no fit argue wit Baba-God wey strong pass am.
- Too many words no dey make-sense, so who dat one epp?
- So who fit sabi wetin dey good for man life, for all hin short life wey no-make-sense, and wey dey fade like shadow? Who fit tell dem wetin go happun for di earth afta dem don komot?