Mark Chapter 8
Jesus Feed Four Thousand
- Those days, plenty pipo con gada, and as dem no get anytin wey dem go chop, Jesus call hin disciples, con tell dem sey,
- “I dey sorry-for dis pipo; dem don already dey wit me for three days, and dem neva chop.
- If I sey make dem dey go dia house as dem neva chop so, dem fit faint for road—becos some of dem come from far-far.”
- Hin disciples con ansa am, “Where we go fit see enuff bread to feed dis pipo, for dis far-far place?”
- Jesus con ask dem, “How many bread una get for there?” Dem ansa am sey, “Na seven bread dey for here.
- He tell di plenty pipo make dem sidon for ground, and afta he collect di seven bread con give tanks, he cut di bread, he give hin disciples so dat dem go give di pipo, naso di disciples do wetin he tell dem.
- Dem get some small fish sef; so Jesus give tanks for di fish, con tell hin disciples make dem share am for di pipo.
- Di pipo chop belleful. Later, hin disciples gada seven baskets of small-small bread wey dem chop-remain.
- Na four thousand men bin dey for there. Afta, he tell dem make dem dey go house,
- he enta inside boat wit hin disciples go Dalmanutha area.
- Di Pharisees come, con dey ask Jesus question to test am. Dem ask am for sign from heaven.
- He hiss, con tok sey, “Why dis generation dey ask for miracle sign? I dey tell una di truth sey una no go see any sign.”
- He komot from dia side, he enta di boat back—con go di oda side.
Di Yeast Of Di Pharisees And Herod
14. Di disciples forget to carry bread, only one bread nahin dem fit carry as dem enta di boat.
15. Jesus con warn dem, “Make una dey careful, and make una watch out for di Pharisees and Herod yeast.”
16. Dem con dey follow demsef dey tok sey, “E be like sey na becos we no carry bread.”
17. Jesus notice wetin dem dey tok about, he con ask dem sey, “Why una dey tok sey una no carry bread? Una neva still see, abi una neva still understand? Naso una heart strong reach?
18. Abi una get eyes but no fit see, and ears but no fit hear? And una no fit remember?
19. Wen I share five bread for five thousand pipo, how many baskets of small-small bread una gada?” Dem ansa am, “Twelve.”
20. And wen I share seven bread for four thousand pipo, how many baskets of small-small bread una gada?” Dem ansa am, “Seven.”
21. He con tok sey, “So una neva still understand?”
As He Take Heal Di Blind Man For Bethsaida
22. Dem reach Bethsaida and some pipo carry one blind man come, and dem beg Jesus make he heal di man.
23. He hold di blind man hand con carry am go outside di village. Afta he spit for di man eyes con lay hin hand for di man body, naso Jesus ask di man sey, “You dey see anytin?”
24. Di man look up con tok sey, “I dey see pipo, dem be like trees wey dey waka.”
25. Naso Jesus touch di man eyes again. Hin eyes open, he con dey see everitin well-well.
26. Jesus tell am make he dey go house, con tell am sey, “No go inside di village.”
Peter Confess Christ
27. Jesus and hin disciples con enta di villages wey dey around Caesarea Philippi. As dem dey go, he ask dem, “Who pipo dey tok sey I be?”
28. Dem ansa am, “Some pipo tok sey you be John di Baptist; odas tok sey you be Elijah; and some of dem tok sey you be one of di prophets.”
29. He con ask dem, “What of una? Who una tink sey I be?” Naso Peter ansa am, “Na you be di Christ.”
30. Jesus warn dem make dem no tell any-pesin about am.”
Jesus Predict Hin Death
31. He con dey teach dem sey, Man-pikin must suffer plenty tins. And di senior-men, chief priests and di teachers of di law go fashi am, he tok sey dem must kill am, but afta three days he go raise up again.
32. He tell dem straight, so Peter con carry am go one corner—con dey change-am-for am.
33. But Jesus turn look hin disciples, con change-am-for Peter, “Komot for my front Satan! You no get Baba-God mata for your mind, but di tins of men nahin full your mind.”
34. Naso he call all di plenty pipo wey gada around am wit hin disciples, he con tok sey: “Any- pesin wey wan follow me must forget hinsef, carry hin cross, con follow me.
35. Any-pesin wey wan save hin life go lose am, but any- pesin wey lose hin life for me and for Baba-God word—go save hin life.
36. Abi e make-sense if man gain di whole world, con lose hin soul?
37. Or wetin man fit give, take exchange for hin soul?
38. If any-pesin dey shame for me and my word for dis ashawo generation wey like to commit sin, Man-pikin sef go shame for am—wen he show wit di holy angels—wit hin Papa levels.”