Mark Chapter 14

Abeg share

Dem Anoint Jesus For Bethany

  1. Na only two days remain for di Passover and di Festival of Bread wit no Yeast, and di chief priests, plus di teachers of di law dey fyne how dem go use style arrest Jesus, con kill am.
  2. But dem tok sey, “No be for di Festival, becos di pipo fit riot.”
  3. As dem dey for table for Simon house—wey bin get leprosy for Bethany, one woman show wit alabaster container of perfume wey cost well-well, and wey dem make wit pure nard. She break di bottle, con pour di perfume for Jesus head.
  4. Some of di pipo wey dey there con dey vex sey, “Why dis woman waste dis perfume?
  5. She for sell am for pesin ‘one year salary,’ con give di moni to poor pipo.” Dem con dey vex for her.
  6. Naso Jesus tok sey, “Make una free her joor! Why una dey disturb di woman? She don do beta tin for me.
  7. Poor pipo go always dey wit una, and una fit epp dem any time wey una like. But I no go always dey wit una.
  8. She don try. She pour perfume for my body to prepare me for my burial wey dey come.
  9. I dey tell una di truth sey, anywhere wey dem preach Baba-God word for di world, dem go remember her becos of wetin she do.”
  10. Naso Judas Iscariot, one of di twelve disciples, go meet di chief priests to betray Jesus to dem.
  11. Dem happy wen dem hear wetin Judas tok, naso dem promise to give am moni. So Judas con dey fyne chance to carry Jesus give dem.

Evening Food Wey Jesus Chop

12. For di first day for di Festival of Bread wit no Yeast, wey dem dey sacrifice di lamb, Jesus disciples con ask am, “Where you wan make we go arrange for you to chop di Passover?”

13. So he send two of hin disciples, he tell dem sey, “Make una go Galilee, una go meet one man wey dey carry container of water. Make una follow am.

14. Tell di owner of di house wey he enta sey, ‘Di teacher dey ask: Where di visitors room, wey I fit chop di Passover wit my disciples?’

15. He go show una one big room wey dey up, dem don arrange di table and chair. Set di place for us.”

16. Di disciples komot for there—con go di city, everitin happun as Jesus tell dem sey e go be. So dem prepare di Passover.

17. As evening reach, Jesus con show wit di twelve disciples.

18. As dem dey for table—dey chop, he tok sey, “I dey tell una di truth, one of una go betray me—pesin wey dey follow me chop.”

19. Dem con dey feel sad, and one by one—dem con dey ask Jesus sey, “I sure sey no be me!”

20. Naso Jesus tok sey, “Na one of di twelve of una—wey dey chop wit me for plate.

21. Man-pikin must die just as dem don write am. But yawa for di man wey go betray Man-pikin! E for beta sey hin mama no born am.”

22. As dem dey chop, Jesus carry bread, he bless am, con cut am, he give hin disciples, con tok sey “Make una take am, na my body.”

23. Naso he carry di cup, he give tanks and he give dem, all of dem con drink am.

24. He con tok sey, “Dis na my blood of di agreement, wey I pour as sacrifice for plenty pipo.”

25. “I dey tell una di truth, I no go drink again from di fruit of di vine—until dat day wen I go drink afresh for Baba-God kingdom.”

26. Afta dem sing one hymn, dem con go di Mount of Olives.

Jesus Predict Sey Peter Go Deny Am

27. As dem dey go, he tell dem sey, “All of una go fashi me.” Dem write am sey, “ ‘Attack di shepherd and all di sheep go jakpa.’

28. But afta I don raise up, I go go Galilee, make una meet me for there.”

29. Peter con tok sey, “Even if everi-pesin fashi you, I no go fashi you.”

30. Jesus ansa am, “I dey tell you di truth today-today, dis night—before di cock go crow two times, you go deny me three times.”

31. But Peter serious tok sey, “Even if I go die wit you, I no go ever deny you.” All of dem con tok di same tin.

Gethsemane

32. Dem reach one place wey dem dey call Gethsemane, Jesus con tell hin disciples sey, “Make una sidon for here make I go pray.”

33. He carry Peter, James and John follow-body, hin body con start to dey bite am, like sey palava plenty for hin head.

34. He con tell dem sey, “My soul dey feel sad well-well like sey I wan die. Make una wait for here—dey watch.”

35. As he reach front small, he kneel down for ground con pray sey, if e dey possible—make time just fly pass.

36. He tok sey, “Chai, Papa, everitin possible for you. Carry dis cup komot from me. But no be by my will—but na by your will.

37. Naso he come back go meet hin disciples, con see dem dey sleep. He call Peter, “Simon, you dey sleep? You no fit watch for only one hour?

38. Watch and pray make una no fall for inside temptation. Di spirit don ready, but di body dey do sme-sme.”

39. Naso he komot again go pray di same tin.

40. Wen he come back, he still see dem dey sleep, becos dia eyes don dey heavy dem. Dem no know wetin to tell am.

41. As he jam dem dey sleep di third time, he con tell dem sey, “Una still dey sleep, dey rest? E don do! Time don reach. See, dem don betray Man-pikin to sinners.

42. Stand up! Make we dey go, di pesin wey go betray me dey come!”

Dem Arrest Jesus

43. As he dey tok, Judas wey be among di twelve disciples con show. Plenty pipo wey di chief priests, di teachers of di law, plus di senior-men send—follow am, dem carry knives and sticks.

44. Judas don arrange sign wit dem sey, “Di pesin wey I go kiss, nahin be di man; arrest am make una carry am go wit una sojas.”

45. Naso Judas waka go meet Jesus, con tok sey, “Teacher!” he con kiss am.

46. Naso dem hollam, con arrest am.

47. One of di disciples wey stand near am drag hin sword come out, con cut di high priest servant ear.

48. So Jesus tok sey, “Shwoo, una carry sword and sticks come catch me—like sey I be tiff?

49. Everi day I bin dey wit una, dey teach una for di worship-place, and una no arrest me. But wetin di Holy-books tok must come to pass.”

50. All of dem con run leave am.

51. One young man wey wear only linen cloth bin dey follow Jesus—as dem hollam,

52. he leave hin cloth—con run naked.

For Front Of Di Council

53. Dem carry Jesus go meet di high priest and all di chief priests, di senior-men, plus di teachers of di law wey gada togeda.

54. Peter follow dem from far reach di high priest palace. He sidon for there wit di guards, con dey warm hin body near di faya.

55. Di chief priests and di whole council dey fyne evidence wey dem go use change-am-for Jesus, so dat dem go fit kill am, but dem no see anytin.

56. Many of dem con lie for hin head, but wetin dem tok no- join.

57. Naso some of dem stand up, con lie for hin head sey,

58. “We hear am tok sey, ‘I go scata di worship-place wey man build, con build anoda one for three days— wey no be man build.’”

59. Upon dat, wetin dem tok no still join.

60. Naso di high priest stand up con ask Jesus sey, “You no go ansa? Wetin all dis men dey tok on top your head?”

61. But Jesus keep quiet—he no ansa dem. Di high priest ask am again, “Na you be di Christ, Baba-God Son?”

62. Jesus con ansa am, “Yes, na me! And you go see Man-pikin as he sidon for Baba-God right hand, and as he dey come wit di clouds of heaven.”

63. Naso di high priest tear hin cloth con ask dem, “Abi we still need any more witness?

64. Una don hear as he take dey downgrade Baba-God. Wetin una tink? All of dem con condemn am—sey he suppose die.

65. Naso some of dem start to dey spit for hin body, dem tie hin eyes, give am blow—dem con tok sey, “Prophesy!” Naso di guards dey beat am.

Peter Deny Jesus

66. As Peter dey down for di palace, one of di high priest house- girl show.

67. Wen she see Peter dey warm hinsef, she look am well- well. She con tok sey, “You sef bin dey wit dat man wey be Jesus of Nazareth.”

68. Peter deny am straight, “I no understand, and I no know wetin you dey tok about,” he con waka go di gate side. Naso di cock crow.

69. Wen di house-girl see am for there again, she tell di pipo wey dey around sey, “Dis pesin na one of dem.”

70. Peter deny am again. Small time, di pipo wey dey stand around con tell Peter sey, “We dey sure sey you be one of dem, you come from Galilee.”

71. He con dey curse hinsef, dey swear sey, “I no know dis man wey una dey tok about.”

72. Naso di cock just crow di second time. Peter con remember wetin Jesus tell am, “Before di cock crow two times, you go deny me three times.” Naso he fall for ground con dey cry.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *