Jeremiah Chapter 18
Di Pot-maker Plus Di Clay
- Dis na di word wey come meet Jeremiah from Baba-God:
- “Go di house of di pesin wey dey mold clay pot, and na for there I go give you my message.”
- So I go house of di pesin wey dey mold clay pot, and I see am dey work wit hin tool.
- But di pot wey di pot-maker dey make wit di clay—con spoil for hin hands; so di artist use di clay of pot wey don spoil, take form anoda pot, con shape am as he like.”
- Naso Baba-God tell me sey:
- “Oh house of Israel, abi I no fit use una do wetin dis pesin wey dey mould pot dey do?” naso Baba-God ask, “As clay be for di hand of di pesin wey dey mould pot, naso una be for my hands, oh house of Israel.
- If at any time I tok anytin about any nation or kingdom, sey I go komot dem, break dem, con scata dem,
- And if dat nation wey I warn—con komot hand from di bad-bad-tins wey dem dey do, den I go stop and I no go wound dem wit di gbege wey I bin plan.
- And if at anoda time I tok about any nation or kingdom, sey I go build am, con stand am gidigbam,
- And if dem do evil tin for my eyes, and dem no gree obey me, dem I go stop di beta tin wey I bin plan for dem.
- “Now Jeremiah, tell di pipo of Judah plus di pipo of Jerusalem sey, ‘Dis na wetin Baba-God tok: Look! I dey arrange yawa for una and I dey plan against una. So make everi one of una turn from una evil ways, and make una change una ways, and make una do good tins.’
Dem Shenk Baba-God Warning
12. But dem go ansa sey, ‘No need. We go kontinu awa ways, everi one of us go do wetin dem dey reason for dia heart.’
13. So na wetin Baba-God tok be dis: ‘Ask di nation: Who don ever hear sometin like dis? Serious tufiakwa nahin my virgin daughter Israel don do.
14. Abi snow dey ever disappear from on top of di mountains of Lebanon? Abi di cold water wey dey flow from far-far mountains dey ever dry?
15. But my pipo don forget me; dem dey burn incense to mumu idols, wey make dem fall for dia ways and from di olden days road, and to make dem waka for corner-corner road wey don spoil;
16. dis tins don make dia land turn to waste, and e turn to disgrace forever; everi pesin wey pass there go shock, and dem go shake dia head.
17. Like heavy-breeze from di east, naso I go take scata dem for front of dia enemies; I go show dem my back instead of my face, on di day of dia wahala.”
Dem Show Jeremiah Pepper
18. Dem con tok sey, “Come make we plan against Jeremiah; becos di priest go always dey preach di truth of Baba-God law, and di wise man go always dey advice us, and di truth no go komot from di prophet mouth. Come make we attack am wit awa tongue, and make we no listen to hin tok.”
19. Listen to me, oh Baba-God; hear wetin di pipo wey dey fight me dey yarn!
20. Abi dem go use evil take pay back good tin? But dem don dig hole for me. Remember sey I stand for your front, and I beg for dem so dat you no go vex for dem.
21. So make hungry catch dia pikin; and allow dem kill dem wit sword. Make dia wives no get pikin and make dem turn to widows. Make pipo kill dia men, and make pipo kill dia young men for war.
22. Make loud cry come from dia house—wen you go carry dia enemies enta dia doormot before dem know, becos dem don dig hole to catch me, and dem don hide trap for my leg.
23. Oh Baba-God, but you know all dia plans to kill me. No forgive dia crimes or komot dia sins from your eyes. Nack dem down for your front. Deal wit dem as you dey vex.