-
Genesis Chapter 5
Di Family of Adam
-
Genesis Chapter 6
Evil Con Dey Control Men Noah 9. Dis na di generations of Noah. Noah na man wey like justice and he dey perfect for hin generation. And Noah follow Baba-God. 10. Noah born three sons, Shem, Ham, plus Japhet. 11. Di earth sef con dey corrupt for Baba-God eyes, and fight-fight nahin brekete for di earth. 12. Baba-God look di earth and true-true di earth corrupt, everi pesin don corrupt hin way for di earth. Noah Build Big Boat Wey Dem Dey Call Ark 13. Naso Baba-God yarn Noah sey, “Di end of everi pesin dey for my front: fight-fight nahin burku for di earth tru dem, and see—I go scata…