Blog

Your blog category

  • Joshua Chapter 13

    Di Land Wey Remaib To Take-over As Dem Take Divide Di Land Wey Dey For Di East Side of Jordan 8. Di oda half of Manasseh, di pipo of Reuben, plus di pipo of Gad don collect dia land wey Moses give dem for di east side of river Jordan, even as Moses wey be Baba-God servant share for dem. 9. Na from Aroer wey dey near river Arnon, and di city wey dey for di middle of di river, plus all di smooth-land of Medeba reach Dibon. 10. Plus all di cities of Sihon, wey di king of Amorites bin dey rule Heshbon—reach di border of di Amonites; 11.…

  • Joshua Chapter 14

    As Dem Divide Di Land For di West Side of River Jordan Caleb Collect Hebron As Hin Share 6. Now di men of Judah come meet Joshua for Gilgal, and Caleb wey be di son of Jephunneh di Kenizzite, con tell am sey, “You know wetin Baba-God tell Moses di man of God about you and me for Kadesh Barnea. 7. I be forty years old wen Moses wey be Baba-God servant send me from Kadeshbarnea to go look di land. And I carry dis message come back to meet am—based-on my church-mind. 8. But my brodas wey go wit me con make di hearts of di pipo shake wit…