Blog
Your blog category
-
1st Samuel Chapter 14
Jonathan Attack Di Philistines Di Pipo of Israel Win Di Philistines 16. Di men wey dey watch for Saul for Gibeah of Benjamin, con look, naso dem see sey di army dey melt komot—and dem scata for everi corner. 17. Naso Saul tell di men wey dey wit am sey, “Gada di sojas, and see di pipo wey don leave us.” Wen dem gada di sojas, con look. Dem notice sey Jonathan and di man wey dey keep hin weapon—no dey for there. 18. So Saul tell Ahijah sey, “Carry Baba-God ark come.” [Dat time Baba-God ark dey wit di pipo of Israel]. 19. As Saul dey follow di…
-
1st Samuel Chapter 15
Saul Second Sin For Gilgal Baba-God Shenk Saul As King 10. Naso message from Baba-God come meet Samuel: 11. “I no dey happy sey I make Saul king, becos he don turn komot from my side, and he no gree do wetin I tell am to do.” Samuel mind con dey worry am, and he cry to Baba-God tru-out di night. 12. Early di next day, Samuel stand up go meet Saul, but dem tell am sey, “Saul don go Carmel to build statue to honor hinsef, and he con go Gilgal.” 13. Wen Samuel reach where he dey, Saul con tok sey, “Make Baba-God bless you! I don do…