Blog

Your blog category

  • 1st Samuel Chapter 18

    David and Jonathan Turn To Padi Saul Con Dey Jealous David 5. Anytin wey Saul send David to do, David do am wit wisdom—sote Saul con give am high rank for di army. All di pipo plus Saul servants con like David sef. 6. E con happun sey wen di men dey go back, afta David kill di Philistine [Goliath], naso di woman come out from all di cities of Israel, to meet king Saul wit singing plus dancing, wit music of happiness and wit sheke-sheke plus music instruments. 7. As dem dey dance, dem con dey sing sey: “Saul don kill thousands and David kill ten thousands.” 8. Saul…