Blog
Your blog category
-
1st Samuel Chapter 22
David Four Hundred Men Saul Kill Di Priests 6. So Saul hear gist sey pipo see David plus hin men. Saul wey carry long-sharp-weapon for hin hand sidon under one tree, for di hill for Gibeah—wit all hin servants wey stand near am. 7. Naso Saul tell all hin servants wey stand round am sey, “Men of Benjamin, make una hear me! Abi Jesse pikin go fit give all of una land and grape-farms? Abi he fit make all of una commanders of thousands, and commanders of hundreds? 8. Why all of una don plan codedly against me? No pesin tell me wen my pikin make agreement wit Jesse pikin.…
-
1st Samuel Chapter 23
David Save Keilah Saul Pursue David 6. And e happun sey wen Abiathar wey be di son of Ahimelech run come meet David for Keilah, he carry priest-cloth follow-body. 7. Naso dem tell Saul sey David don go Keilah. So Saul tok sey, “Baba-God don put David for my hand, becos David don trap hinsef as he enta town wey get gates and walls.” 8. Naso Saul gada all hin army for war, to go Keilah, con surround David and hin men. 9. Wen David con sabi sey Saul dey plan against am, he tell Abiathar wey be di priest sey, “Carry di priest-cloth come here.” 10. David con tok…