Blog
Your blog category
-
2nd Samuel Chapter 1
David Hear As Saul Take Die David Cry For Saul Plus Jonathan 17. Naso David compose burial song for Saul plus Jonathan. 18. And he command sey make di pipo of Judah learn di song. Di name of di song na, ‘Di Song of Bows,’ and dem write am for di Book of Jashar. 19. “Chai Israel, your levels dey lie down for ground for on top mountain. See as strong men take fall! 20. Make una no tok di story for Gath, make una no tok di gist for di streets of Ashkelon, unless di daughters of di Philistines go dey happy, and di daughters of di pipo wey…
-
2nd Samuel Chapter 2
David Na King of Judah War Between Israel Plus Judah 8. But Abner wey be di son of Ner, di commander of Saul army, con carry Ish-Bosheth wey be Saul son, con carry am come Mahanaim. 9. He make am king of Gilead, Ashuri plus Jezreel, and even Ephraim, Benjamin plus di whole of Israel. 10. Ish-Bosheth wey be Saul son na forty years we dem make am king of Israel, and he reign for two years; but di house of Judah follow David. 11. David be king of di house of Judah for Hebron—for seven years and six months. 12. Abner wey be di son of Ner, togeda wit…