Blog

Your blog category

  • 2nd Samuel Chapter 7

    Baba-God Promise To David Di Prayer of David 18. Naso David go inside, con sidon for Baba-God front, and he tok sey: “Who I be, chai  Baba-God Almighty? And which level my family get wey you carry me go far-far? 19. And dis one na just small tin for your eyes, Oh Almighty God, you don tok about di future of your servant house sef. Naso you take dey always run-tin wit men, chai, Almighty God? 20. “I no fit tell you pass dis one, you know wetin your servant true-true be, Almighty God! 21. Sake of your word, and based-on your will, you don do all dis ogbonge tins,…

  • 2nd Samuel Chapter 8

    Di Fights Wey David Win David Officials 15. David rule as king of all Israel, and he give judgement plus justice to all hin pipo. 16. Joab wey be di son of Zeruiah nahin dey control di army; Jehoshaphat wey be di son of Aliud nahin dey keep history. 17. Zadok wey be di son of Ahitub plus Ahimelech wey be di son of Abiathar na priests; Seraiah na writer (secretary). 18. Benaiah wey be di son of Jehoiada nahin dey control di Cherethites plus di Pelethites; and David sons na chief leaders.