Blog

Your blog category

  • 2nd Samuel Chapter 15

    Absalom Plan Against Di King David Run 13. One messenger come, con tell David sey, “Di hearts of all di men of Israel dey wit Absalom.” 14. Naso David tell all hin servants wey dey wit am for Jerusalem sey, “Make una come, we must run or none of us go fit escape from Absalom. We must komot sharp-sharp or he go come catch us kpakpakpa, and he go cos kasala for us, con use sword take kill pipo for di city.” 15. Di king servants con tell di king sey, “Your servants dey ready to do anytin wey awa oga di king choose.” 16. Naso di king enta road…

  • 2nd Samuel Chapter 16

    David Wit Ziba Shimei Curse David 5. As king David dey reach Bahurim, one man from there con show-face. Di man na from Saul family. Hin name na Shimei wey be di son of Gera, he con dey curse David as he dey come out. 6. He stone di king plus di king servants, plus all di strong sojas wey surround di king. 7. As he dey curse, he tok sey, “Komot from here, komot from here, you wey be killer and jaduga!” naso he dey shout, 8. “Baba-God don pay you back for all di blood wey you shed for Saul family, and wey you take hin place as…