Blog

Your blog category

  • 1st Kings Chapter 3

    Solomon Ask For Wisdom Wise Judgement 16. Now two ashawo come meet di king, con stand for hin front. 17. So one of dem tok sey, “My oga, me and dis woman dey live for di same caban (house). I born pikin as she dey for there wit me. 18. E con happun sey di third day afta I born my pikin, dis woman sef born her pikin. We bin dey togeda; no pesin dey for di house wit us, only di two of us. 19. “Naso dis woman son con die for night becos she lie down on top of her pikin. 20. So she stand up for mid-night,…

  • 1st Kings Chapter 4

    Solomon Official Plus Govnors Solomon Prosper 20. Di pipo of Judah plus Israel con plenty like sand-sand for beach; dem chop; dem drink and dem con dey happy. 21. Solomon rule all di kingdoms from di River reach di land of di Philistines, far-far reach di border of Egypt. Dis kontris bring gifts and dem serve Solomon all di days of hin life. 22. Di supply wey Solomon need everi day na; 5,000 liters of beta flour plus 10,000 liters of wheat flour; 23. 10 ororbor malu, 20 malu wey dem feed from fields, 100 sheeps, and even deer, gazelles, roebuck, plus fat fawo. 24. He rule all di kingdoms…