Blog

Your blog category

  • 1st Kings Chapter 21

    Naboth Grape-farm Jezebel Plan 8. So she use Ahab name take write letters, con put hin seal on dem, con send dem go meet di senior-men and di princes wey dey stay for Naboth city wit am. 9. She write for inside di letters sey: “Make una declear day of fasting and make Naboth sidon for high table among di pipo. 10. But make two jaguda pipo sidon opposite am, and make dem tok sey, ‘You don curse both Baba-God plus di king!’ Den you go carry am go outside to stone am to death.” 11. So di senior-men plus di princes wey dey stay for Naboth city do wetin…

  • 1st Kings Chapter 22

    Micaiah Prophesy Against Ahab Dem Kill Ahab 29. So di king of Israel plus Jehoshaphat wey be di king of Judah con go Ramoth Gilead. 30. Naso di king of Israel tell Jehoshaphat sey, “I go disguise mysef, con go fight, but make you wear your king cloth.” So di king of Israel disguise hinsef and he con go fight. 31. Now di king of Syria tell hin thirty two captains of hin horse-moto sey, “No fight wit any small or big pesin, only fight wit di king of Israel!” 32. E con happun sey wen di captains of di horse-moto see Jehoshaphat, dem con tok sey, “Surely, na di…