Blog

Your blog category

  • 2nd Kings Chapter 9

    Dem Anoint Jehu as King of Israel Jehu Kill Joram Plus Ahaziah 14. So Jehu wey be di son of Jehoshaphat, wey be di son of Nimshi, con plan against Joram. [Now Joram plus di whole of Israel bin dey defend Ramoth-Gilead against Hazael wey be di king of Syria, 15. but king Joram bin go back to Jezreel to heal from di wounds wey di Syrians bin wound am for di war against Hazael di king of Syria]. Jehu con tell di men wey dey wit am sey, “If una wan make I be king, no let any pesin survive from di city to go tok di news for…

  • 2nd Kings Chapter 10

    Dem Kill Ahab Family Dem Kill Di Prophets of Baal 18. Naso Jehu gada all di pipo togeda, con tell dem sey, “Ahab worship Baal small, but Jehu go worship am well-well. 19. Now make una call all di prophets of Baal, all hin servants plus all hin priests. Make sure sey no one of dem dey miss among dem, becos I wan do big sacrifice for Baal. Any pesin wey no gree come go die.” But Jehu dey whyne dem so dat he go fit kill di pipo wey dey worship Baal. 20. Jehu tok sey, “Make una gada di pipo togeda to worship Baal.” So dem go spread…