Blog
Your blog category
-
2nd Kings Chapter 19
Isaiah Give Hezekiah Assurance Di Prayer of Hezekiah 14. Hezekaih receive di letter from di messengers and he read am. Naso he go Baba-God house, con spread di letter open for Baba-God. 15. And Hezekiah pray to Baba-God: “Chai Baba-God, God of Israel wey sidon for di king-chair between di cherubim, na only you be Baba-God wey dey rule all di kingdoms of di world. Na you make di heavens plus di earth. 16. Listen oh Baba-God, and make you hear, open your eyes, chai Baba-God, and make you see, listen to di words wey Sennacherib send to insult Baba-God wey dey alive. 17. “No be lie, Oh Baba-God, di…
-
2nd Kings Chapter 20
Hezekiah Sickness Hezekiah Make Mouth About Di Tins Wey He Get 12. Around dat time, Merodach-Baladan wey be di son of Baladan—di king of Babylon send letters plus gift to Hezekiah, becos he bin hear sey Hezekiah dey sick. 13. Hezekiah receive di messengers, con show dem everi beta tin wey dey inside hin store—di silver, di gold, di spices, plus di beta ororo, hin weapon-house, plus everitin wey dey among di beta-beta-tins wey he get. E no get anytin wey dey for di palace or di kingdom wey Hezekiah no show dem. 14. Naso Isaiah di prophet go meet Hezekiah, con ask am sey, “Wetin those men tok,…