Blog
Your blog category
-
1st Chronicles Chapter 14
David Prosper David Win Di Philistines 8. Wen di Philistines hear sey dem don anoint David as king of Israel, dem go up wit full force to fyne David, but David hear about am, con go out to face dem. 9. So di Philistines come spread demsef for bottom-of-di-mountain wey dem dey call Rephaim, 10. So David ask Baba-God, “Make I go attack di Philistines? You go carry dem put dem for my hand?” Naso Baba-God ansa am, “Dey go, I go carry dem put for your hand.” 11. So David and hin men go Baal Perazim, and David kill dem for there. He con tok sey, “As water take…
-
1st Chronicles Chapter 15
David Carry Di Ark Go Jerusalem