Blog

Your blog category

  • 1st Chronicles Chapter 22

    David Arrange To Build Baba-God House Arrangement For Baba-God House 2. David give orders make dem gada all di foreigners wey dey live for Israel, and he choose pipo wey go dey cut stones from among dem—so dat dem go prepare stones wey dem cut, to build Baba-God house. 3. He give dem plenty iron wey dem go use take make nails for di doors of di gates and for di joints, and plenty bronze wey dem no fit measure, 4. And plenty cedar woods wey dem no fit count, becos di pipo of Sidon plus Tyre carry plenty cedar woods come meet David. 5. David con tok sey, “My…

  • 1st Chronicles Chapter 23

    Di Levites Gershonites 7. Dis ones belong to di Gershonites: Ladan plus Shimei. 8. Dis na di sons of Ladan: Jehiel na di firstborn, den Zetham plus Joel—all of dem na three. Na dis be di head of di families of Ladan. 9. Dis na di sons of Shimei: Shelomoth, Haziel plus Haran—all of dem na three. Na dem be di heads of di families of Ladan. 10. And di sons of Shimei na: Jahath, Ziza, Jeush plus Beriah. Na dis be di sons of Shimei—all of dem na four. 11. Jahath nahin be di first and Ziza na di second, but Jeush plus Beriah no get many sons, so…