Blog
Your blog category
-
2nd Chronicles Chapter 1
Baba-God Give Solomon Wisdom Di Tins Wey Solomon Get 14. Solomon get plenty horse-moto and horse-riders. He get 1,400 horse-moto plus 12,000 horses. He keep dem for cities of horse-moto and wit di king for Jerusalem. 15. Di king make silver plus gold plenty well-well like stone for Jerusalem; cedar trees con burku like sycamore fig trees for di lowlands. 16. Solomon bring hin horses from Egypt, and from Kaveh; di king market-pipo buy dem from Kaveh for di current price. 17. Dem pay 600 pieces of silver for everi single one of di horse-moto from Egypt, and 150 pieces of silver for everi single horse. Dem still sell horse-moto plus horses for abroad—to all di kings of di Hittites and to di kings of Syria.
-
2nd Chronicles Chapter 2
Solomon Gada Building Materials for Baba-God House Huram Agree To Epp 11. King Huram of Tyre con send dis letter go meet Solomon: “Becos Baba- God love hin pipo, he don make you be dia king.” 12. Huram still tok sey, “Blessings (praises) for Baba-God di Oga of Israel, wey make di heaven plus di earth! He don give King David wise pikin, wey get-sense plus understanding, and he go build Baba-God house, and even palace for hinsef. 13. Now I dey send one man wey sabi well-well, na man wey get understanding; Huram my artist wey too sabi. 14. Hin mama na from Dan and hin papa na from Tyre. He sabi work wit gold, silver, bronze, iron, stones, plus wood, and even purple, blue, and crimson cloth, plus fine linen. He sabi how to do everi kind of engraving and he understand any design wey you go give am. He go work wit your…