Blog

Your blog category

  • 2nd Chronicles Chapter 9

    Di Queen of Sheba [Bilikisu sunbgo] Cut-cap For Solomon Solomon Too Much Moni plus Beta-beta-tins 13. Solomon dey colllect almost 23 tons of go ld everi year, 14. Apart from wetin he collect from di business-pipo and market-pipo. All di Arabian kings plus di govnors of di land still bring gold and silver come meet Solomon. 15.King Solomon make 200 big shields wit gold, Everi single one of dem weigh reach 3 kilograms of gold.16. He still make 300 small shields wit gold. Everi single one of dem weigh reach 2 kg of gold. Di king put dem for di Palace of di  Forest of Lebanon. 17. Di king make big king-chair wey dem design wit ivory, and dem cover am wit pure gold. 18. Na six steps dem dey use take climb up to di king-chair, and one gold stool gum-join di king-chair. Di king-chair get two place to rest hand put, wit…