Blog

Your blog category

  • 2nd Chronicles Chapter 11

    Rehoboam As King of Judah Rehoboam Make Di Cities Strong Well-well 5. Rehoboam live for Jerusalem; he build dis strong cities wit wall tru-out Judah: 6. He build even Bethlehem, plus Etam, and Tekoa, 7. Beth Zur, Soco, plus Adullam, 8. Gath, Mareshah, and Ziph, 9. Adoraim, Lachish, plus Azekah, 10. Zorah, Aijalon, and Hebron. Na dis be di strong cities wit wall—for Judah and Benjamin. 11. He make dis cities strong, con build dia wall, and he put officers for there, and even store-houses for food, ororo, and wine. 12. He put shields plus long-sharp-weapons for dis cities; he con make dis cities strong well-well. So only Judah plus Benjamin nahin he con dey control. Di Priests Plus Di Levites Move Go Judah 13. Di priests plus di Levites wey dey stay tru-out Israel support am, no mata where dem dey stay. 14. Di Levites even leave dia farmland plus dia property, and dem come Judah and Jerusalem, becos Jeroboam and hin sons stop dem from serving as priests for Baba-God. 15. Jeroboam…

  • 2nd Chronicles Chapter 12

      Egypt Attack Judah Di End of Rehoboam As King 13. King Rehoboam make hin govment stand gidigbam for Jerusalem; na forty-one years old wen he climb di king-chair and he rule for seventeen years for Jerusalem, di city wey Baba-God choose from all di tribes of Israel to be place for hin name. Rehoboam mama na from Ammon and her name na Naamah. 14. He do evil tin becos he no set hin mind to follow Baba-God. 15. As for di tins wey happun wen Rehoboam be king, from starting to ending, dem write dem for di books of History of Shemaiah di prophet, and di Book of Iddo di prophet about di history of di generations. Naso Jeroboam and Rehoboam dey always fight wars. 16. So Rehoboam die, and dem bury am for di City of David. Hin son Abijah, con take hin place as king.