Blog
Your blog category
-
2nd Chronicles Chapter 19
Jehu Correct Jehoshaphat Di Changes Wey Jehoshaphat Make 4. Jehoshaphat stay for Jerusalem. He go out among di pipo, from Beer-sheba to di mountain of Ephraim, and he ginger dem to follow Baba-God wey be di Oga of dia ancestors. 5. He choose judges tru-out di land, and for everi single strong city of Judah. 6. He con tell di judges sey, “Make una calm down to reason wetin una dey do, becos una no dey judge for men, but na for Baba-God wey go dey wit una wen una dey judge mata. 7. Make una fear Baba-God, con calm down to reason wetin una dey do, becos Baba-God awa Oga no like make dem judge mata in a wrong way, and he no like partiality, plus bribe.” 8. For Jerusalem, Jehoshaphat choose choose some Levites, priests, plus leaders of di families of Israel to judge for Baba-God and to settle mata among di pipo. And dem stay for Jerusalem. 9. He tell dem sey: “Make una…
-
2nd Chronicles Chapter 20
Moab Attack Jehoshaphat : ‘No let fear catch una, and no let una mind cut, becos of dis big army! Becos no be una go fight di fight, but na Baba-God go fight di fight. 16. Make una march down against dem tomorrow, dem dey climb go up tru di up-road of Ziz. Una go see dem for di end of di river for front of Desert of Jeruel. 17. Una no go fight dis fight. Make una take una positions, stand gidigbam, and watch as Baba-God go take save una, oh Judah plus Jerusalem. Make una no fear, and no let una mind cut! Tomorrow make una march out go face dem; Baba-God go dey wit una!” 18. So Jehoshaphat bow down wit hin face for ground, and all di pipo of Judah plus Jerusalem fall down for Baba-God front, con dey worship am. 19. Naso some Levites, from di family of Kohath and Korah, stand up, con dey praise Baba-God, di Oga of Israel—wit loud voice. 20. Early di next morning, dem march out go di Desert of Tekoa. Wen dem ready to march, Jehoshaphat stand up, con tok sey: “Make una listen to me, pipo of Judah and pipo…