Blog
Your blog category
-
2nd Chronicles Chapter 23
Dem Crown Joash As King of Judah As Athaliah Take Kpeme 12. Wen Athaliah hear di noise of di pipo wey dey run upandan, as dem dey shout and praise di king, naso she come meet di pipo wey gada for Baba-God house. 13. So she see di king dey stand near hin pillar for di doormot. Di officers plus di pipo wey dey blow di trumpets stand near di king, all di pipo of di land dey celebrate, dem dey blow trumpets, and di musicians wit different-different music instruments, plus those wey dey lead di songs of praise. Naso Athaliah tear her clothes con dey shout, “Una betray me! Una plan against me!” 14. Jehoiada di priest con send di commanders of hundred sojas, wey dey in charge of di sojas, con tell dem sey, “Bring her come outside Baba-God house to di guards. Use sword take kill any pesin wey follow her”—becos di priest bin tok sey, “Make dem no kill her for inside Baba-God house.” 15. Naso…
-
2nd Chronicles Chapter 24
Joash Repair Baba-God House Jehoiada Kpeme 15. But Jehoiada con old, and he kpeme. Na one hundred and thirty years old wen he kpeme. 16. So dem bury am for di City of David wit di kings, becos he do beta tins for Israel and for Baba-God, and di worship-place. Di Wickedness of Joash 17. Afta Jehoiada kpeme, di princes of Judah visit di king, and dem bow for di king. So di king listen to dia advice. 18. Naso dem fashi Baba-God house, di God of dia papa-papa-papa, and dem worship di images of di goddess of Asherah and idols. Becos of dis evil tin wey dem do, Baba-God con vex for Judah plus Jerusalem. 19. Naso Baba-God send prophets among dem to carry dem back to am. Dem warn di pipo, but dem no gree hear word. 20. So Baba-God Spirit ginger Zechariah wey be di son of Jehoiada di priest. He stand up for front of di pipo, con tell dem sey, “Baba-God tok sey: ‘Why una dey break Baba-God law so dat e no…