Blog
Your blog category
-
2nd Chronicles Chapter 25
Amaziah As King of Judah Amaziah War Against Edom 5. Amaziah gada all di men of Judah and he make commanders of thousand men and commanders of hundred men—based-on dia papa house, tru out Benjamin plus Judah. He count those wey be from twenty years old go up, and he see 300,000 strong men wey fit fight war, and wey fit use shield plus long-sharp-weapon. 6. He employ 100,000 strong fighters for Israel, con pay 3.4 tons of silver. 7. But one man of God visit am, con tell am sey: “Oh king, no let di army of Israel follow you go, becos Baba-God no dey wit Israel or di pipo of Ephraim. 8. Even if you go, con fight well-well for di war, Baba-God go make you fall for front of your enemies. Baba-God get di pawa to epp you, or fall your hand.” 9. Naso Amaziah ask di prophet sey, “But wetin I go con do about di 3.4 tons of silver wey I don pay di armies of Israel?” So di man of God ansa am, “Baba-God fit give you wetin pass…
-
2nd Chronicles Chapter 26
Uzziah Na King for Judah Uzziah Pay Becos He Day Feel-big 16. But once he con get pawa, he fall becos he con dey feel-big. He no gree obey Baba-God wey be hin Oga. He enta inside Baba-God house to burn incense for di incense altar. 17. Azariah di priest plus eighty oda Baba-God priests wey get-mind, con follow am enta. 18. Dem face King Uzziah, con tell am sey, “Uzziah, e no dey right for you to burn incense to Baba-God. Na di work of di priests be dat, di pikin-pikin-pikin of Aaron, wey dey holy to burn incense. Komot from di holy-place, becos you don disobey, and Baba-God no go honor you!” 19. So Uzziah, wey carry incense-container for hin hand, con dey vex. As he dey use vex follow di priests tok, leprosy just show-face for hin forehead, for there, for front of di priests, for inside Baba-God house, near di incense altar. 20.Wen Azariah di high priest, plus di oda priests look am, dem con see sey leprosy dey for hin forehead. Naso dem carry am sharp-sharp komot from there; even di king hinsef wan komot sharp-sharp, becos Baba-God don nack am. 21. King Uzziah get leprosy until di day wey he die. He live for separate house, di leprosy wey he get make dem stop am make he no dey enta Baba-God house. Hin…