Blog

Your blog category

  • 2nd Chronicles Chapter 29

      Hezekiah As King of Judah Hezekiah Clean Baba-God house 3. For di first month of di first year as king, he open di doors of Baba-God house, con repair dem. 4. He bring di priests plus Levites, and he gada dem for di east street. 5. He con tell dem sey: “Make una listen to me, una wey be Levites! Now make una clean unasef, so dat una go fit clean di worship-place of Baba-God di Oga of una ancestors! And make una komot everitin wey no clean  from inside di holy-place! 6. Becos awa papa turn komot from Baba-God; dem do evil tins for Baba-God eyes, and dem fashi Am! Dem throway-face komot from Baba-God holy-place, and dem turn dia backs. 7. Dem close di doors of di room wey dem take dey enta Baba-God house, con off di lamps; dem no gree burn incense or sacrifice burnt offering for di holy-place of Baba-God of Israel. 8. Baba-God con dey vex for Judah plus Jerusalem, sote he carry…