Blog

Your blog category

  • 2nd Chronicles Chapter 31

    Di Changes Wey Hezekiah Make             Di Pipo Give For Baba-God House 2. Hezekiah con organize di priests plus Levites for groups, based-on di work wey dem dey do—to give burnt offerings plus peace offerings, to serve, to give tanks, and to sing praises for di gates of Baba-God house. 3. Di king give some of hin own animals for burnt sacrifices, even for di morning and evening burnt sacrifices, plus di burnt sacrifices wey dem dey do for Sabbaths, New moon festivals, and for oda festivals everi year—wey dey for inside Baba-God law. 4.Evensef, he tell di pipo wey dey stay for Jerusalem to bring di offerings wey dem suppose bring for di priests and Levites, so dat dem go fit put dia full mind for Baba-God law. 5. Wen di pipo hear wetin di king want, di pipo…

  • 2nd Chronicles Chapter 32

    Sennacherib Make-mouth Against Judah As Dem Take Win Sennacherib and As He Take Kpeme 20. King Hezekiah plus prophet Isaiah wey be di son of Amoz con pray about dis tin and dem cry out to heaven. 21. Naso Baba-God send one angel, and he wipe out all di soldiers, princes, and officers for di army of di king of Assyria. So Sennacherib go back to hin  own land wit shame. Wen he enta di shrine of hin god, some of hin own  pikin con kill am wit sword. 22. Baba-God save Hezekiah plus di pipo of Jerusalem from di pawa of King Sennacherib of Assyria and from all di oda nations. He make dem safe for everi angle. 23. Many pipo con dey bring gifts to Baba-God for inside Jerusalem, plus beta-beta gifts to King Hezekiah of Judah. From dat time go, all di nations con dey look am wit high levels.         Hezekiah Sempe 24. Those days, one sickness con catch Hezekiah—sote he wan even die. But he pray…