Blog

Your blog category

  • 2nd Chronicles Chapter 33

    Manasseh As King of Judah Manasseh Repent 10. So Baba-God tok to Manasseh and hin pipo, but dem no gree listen. 11. Baba-God con bring di commanders of di army of di king of Assyria against dem. Dem gbab Manasseh, dem put hooks for hin nose, dem tie am wit bronze chains, con carry am go Babylon. 12. From inside hin pain Manasseh ask Baba-God wey be hin Oga to sorry-for am, and he true-true humble hinsef for Baba-God of hin ancestors. 13. Wen he pray to Baba-God, Baba-God ansa am, con ansa am wit favour—for hin cry for mercy. Baba-God carry am come back to Jerusalem, to hin kingdom. Naso Manasseh sabi sey Baba-God na Oga. 14. Afta dis, Manasseh build up di outside wall of di City of David for di west side of bottom-of-di-mountain of Gihon—go reach di doormot of di Fish Gate and round di part of di City wey dem dey call Ophel; he make am high well-well. He con put army officers for all di strong cities wey get wall for Judah. 15. He komot di foreign gods plus images from Baba-God house, plus all di altars wey…

  • 2nd Chronicles Chapter 34

    Josiah As Good King of Judah Josiah Scata Di Idols 3. For di eighth year wen he be king, wen he still young, he start to dey  follow di God of hin papa-papa-papa David. For hin twelfth year as king, he start to dey komot di shrines from Judah plus Jerusalem, he komot di images of Asherah, di idols, plus images. 4. Dem scata di altars of Baals for hin front, con break di incense altars wey dey on top of dem. He scata di images of Asherah, di images wey dem carve, con break di images wey dem mold. He grind dem to dust, con sprinkle di dust for di graves of di pipo wey bin dey give dem sacrifice. 5. He burn di bones of di priests of di idols for dia altars, and he clean Judah plus Jerusalem. 6.…