Blog

Your blog category

  • 2nd Chronicles Chapter 35

      Josiah Celebrate Di Passover         Josiah Die For War 20. Afta king Josiah don do all dis tins for Baba-God house, King Necho of Egypt march come out to fight war against Carchemish near River Euphrates. Naso Josiah march out to fight am. 21. So Necho send messengers go meet am, sey, “Which business we get  togeda, Oh king of Judah? I no dey attack you today, I dey go fight anoda kingdom and Baba-God tell me to do sharp-sharp. No try to stop Baba-God work, Baba-God dey wit me, or else he go kill you.” 22. But Josiah no gree turn back from am; he disguise hinsef for war. He no take di words of Necho wit seriousness—message wey he receive from Baba-God; naso Josiah go fight Necho for bottom-of-di-mounatin wey dem dey call Megiddo. 23. Naso dem use arrow take shoot King Josiah; so di king tell hin servants sey, “Carry me komot, becos dem don wound me seriously.” 24. So hin servants carry am komot from di horse-moto, dem put am for anoda horse-moto wey belong to am, con carry am come Jerusalem, and na for there he die. Dem bury am for di…

  • 2nd Chronicles Chapter 36

    Jehoahaz As King of Judah           Jehoiakim As Evil King of Judah 5. Jehoiakim na twenty-five years old wen he be king, and he be king for eleven years for Jerusalem. He do evil tins for Baba-God eyes. 6. King Nebuchadnezzar of Babylon attack am, he tie am wit bronze chains, con carry am komot go Babylon. 7. Nebuchadnezzar carry some properties from Baba-God house, go Babylon and he put dem for inside hin palace for there. 8. Di rest tins wey happun wen Jehoiakim be king, plus di tufiakwa tins wey he do, and di wrong tins wey he do—dem write dem for di Book of di Kings of Israel and Judah. Hin son Jehoiachin con take hin place as king. Jehoiachin As Evil King of Judah 9. Jehoiachin na eighteen years wen he climb di king-chair, and he be king for three months and ten days for Jerusalem. And he do bad-bad-tins for Baba-God eyes. 10. For di starting of di year King Nebuchadnezzar sey make dem carry am come Babylon, wit di beta-beta-tins wey dey for inside Baba-God house. Nebuchadnezzar con make hin uncle, Zedekiah, as king of Judah plus Jerusalem. Zedekiah As King of Judah 11. Zedekiah na twenty-one years old wen he climb di king-chair, and he  rule for eleven years for Jerusalem. 12.…