Blog
Your blog category
-
Ezra Chapter 3
Dem Build Di Altar Again Dem Build Baba-God House Again 7. Dem give moni to di stone-workers, and carpenters, and dem bring cedar woods from di pipo of Tyre and Sidon. Dem still pay di Tyre plus Sidon—wit food, plus drinks and ororo. So dem bring di woods from Lebanon, and dem float dem come from di Mediterranean Sea go Joppa, just as king Cyrus of Persia tell dem to do. 8. On di second month of di second year afta dem reach Baba-God house for Jerusalem, Zerubbabel wey be di son of Shealtiel, Jeshua wey be di son of Jozadak, plus di rest of dia brodas (di priests plus…
-
Ezra Chapter 4
Badbelle Pipo No Want Make Dem Build Baba-God House Di Letter To Artaxerxes 6. For di starting of wen Artaxerxes be king, dem carry mata put for di pipo of Judah and Jerusalem. 7. And for di days of Artaxerxes wey be di King of Persia; Bishlam, Mithredath, Tabeel plus di rest of dia padi write letter to Artaxerxes. Dem write di letter wit Aramaic language and dem translate am for di king. 8. Rehum wey be di commander, plus Shimshai wey be di writer, write letter against Jerusalem—to Artaxerxes wey be di king: 9. Rehum wey be di commander, plus Shimshai wey be di writer, togeda wit di rest…