Blog
Your blog category
-
Ezra Chapter 9
To Marry Foreigners Ezra Prayer of Confession 5. Den for di evening sacrifice, I stand up from my sadness wit all my clothes wey don tear. I kneel down con raise my hand up to Baba-God my Oga. 6. I con tok sey, “Kai my God, shame plus disgrace dey catch me well-well to face you, my God, becos awa sins don high pass awa heads and awa sins don high reach di heavens. 7. From di days of awa papa-papa-papa till now, awa sins burku. Becos of awa sins, we and awa kings plus awa priests don fall enta di kings of di lands, we don die by sword…
-
Ezra Chapter 10
About Mix-marriage Wey No Good Dem Komot Dia Foreign Wives 18. Among di pikin-pikin-pikin of di priests, dis pipo marry foreign women: From di family of Jeshua wey be di son of Jozadak, and hin brodas: Maaseiah, Eliezer, Jarib plus Gedaliah. 19. (All of dem put dia hand to confam di agreement sey dem go pursue dia foreign wives, and everi single one of dem bring one-one ram for dia sin. 20. From di family of Immer: Hanani plus Zebadiah. 21. From di sons of Harim: Maaseiah, Ishmael, Nathanel, Jozabad and Elasah. 22. From di sons of Pashhur: Elioenai, Maaseiah, Ishmael, Nethanel, Jozabad plus Elasah. 23. Among di Levites: Jozabad,…