Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 17

    Di PrayerOf Innocent Man 1. Dis na prayer of David. Oh Baba-God, hear my cry for justice, listen to my cry. Hear my prayers—my prayers no be from wuru-wuru lips. 2. From your front nahin you go take confam sey I dey right; make your 3. You don test my heart, you don observe me for night, you don try me—and you no see anytin. I don decide sey my mouth no go commit sin. 4. As for di works of men, by di yarnings of your lips, I don keep myself from following di way of evil pipo. 5. Hold my leg for your way, so dat my leg…

  • Psalm Chapter 18

    Dis Na Song Of Victory 1. For di producer of music. Dis na Psalm of David—servant of Baba-God, wey use di yarnings of dis song follow Baba-God tok, di day wey Baba-God save am from di hands of hin enemies, and from di hands of Saul. And he tok sey: I go love you, Oh Baba-God wey be my pawa. 2. Na Baba-God be my rock, my strong house, and saviour; Baba-God na my pawa wey I go trust, na my guard, and di horn wey dey save me, plus my secure place. 3. I go call Baba-God wey get levels to receive my praise, and naso I go save…