Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 103

    Di Love Of Baba-God 2. Praise Baba-God, Oh my soul, and make you no fashi all di beta tins wey he dey do. 3. Nahin dey forgive all your sins, con heal all una diseases, 4. Nahin dey save your life from scata-scata, con crown you wit soft-love plus mercy. 5. Nahin dey put beta tins for your mouth—sote your youth go dey ginger like eagle. 6. Baba-God dey show goodness plus justice to everi pesin wey dey under oppression. 7. He show Moses hin way, and he show hin handwork to di pipo of Israel. 8. Baba-God dey sorry-for pesin, and he dey kind, he no dey quick vex,…

  • Psalm Chapter 104

    2. He wrap hinsef inside light like cloth; he stretch out di heaven like curtain, 3. con lay di pillar for di roof of hin house for inside water for up-up. He turn di clouds to hin horse- moto, con ride on top of di feathers of di heavy-breeze. 4. He make hin angels as spirits, and hin servants like faya wey dey burn. 5. He set di earth put for e foundations; make e no-fit move forever. 6. You cover di earth wit big-big-water like cloth, di water con high pass even di mountains. 7. Di water run go back wen you tok, di water rush komot as dem…