Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 115

    Di One Real God 2. Why world-pipo [Gentiles] go dey tok sey, “Where dia God dey?” 3. But awa God dey for heaven, he dey do wetin dey for hin mind. 4. But dia idols na silver plus gold, wey men make wit dia hands. 5. Dem get mouth—but dem no-fit tok. Dem get eyes—but dem no-fit see. 6. Dem get ears—but no-fit hear word, and dem get nose—but dem no-fit smell; 7. dem get hands—but dem no-fit feel; dem get leg—but dem no-fit waka. Dem no fit make one single sound wit dia throat. 8. Those pipo wey dey make dem be like dem, naso everi-pesin wey trust dem…

  • Psalm Chapter 116

    Saved From Death 2. Becos he turn hin ears face my side, so I go call Baba-God—as long as I dey alive. 3. Di ropes of death surround me; and di pains of death hold me. See me see trouble, see me see wahala. 4. I con call Baba-God name: “Chai Baba-God, biko save my soul!” 5. Baba-God dey kind, and he dey good, and he dey sorry-for pesin. 6. Baba-God dey protect ordinary pipo; wen I bin dey low-key, and he save me. 7. Chai my soul, make you relax again, becos Baba-God dey good to me. 8. Oh Baba-God, you don free my soul from death, and my…