Blog
Your blog category
-
Psalm Chapter 129
Dis Na Prayer Against Israel Enemies 2. dem don dey oppress me no-be small, since I be small pikin, but my head too strong for dem. 3. Dem don dig my back as farmer take dey dig hole for ground to plant seed. 4. But Baba-God dey good, he don cut di ropes of wicked men to pieces. 5. Make shame catch all di pipo wey hate Zion, and make dem turn back. 6. Make dem be like grass for roof, wey dey dry even before e grow; 7. wey di farmer no-fit harvest, or wey dem no-fit tie for bundle. 8. Make those pipo wey dey waka pass no…
-
Psalm Chapter 130
I Dey Hope For Freedom 2. Oh Abasi (Baba-God), hear my voice, and make your ears listen to wetin I dey ask for. 3. Oh Baba-God, If to sey you dey write pipo sins for book, who go fit stand? 4. But forgiveness dey for your hand; so dat pipo go dey fear you. 5. I dey wait for Baba-God, my whole soul dey wait, and na inside hin word I dey put my hope. 6. My soul dey wait for Baba-God—pass as vigilante take dey wait make morning reach, yes, I dey wait pass as vigilante take dey wait make morning reach. 7. Oh Israel, put your hope on…