Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 135

    Di Real God Plus Idols 2. You wey dey serve for Baba-God house, inside di yard of di house of awa God. 3. Praise Baba-God, Baba-God good; e make-sense to sing praises to hin name. 4. Baba-God don choose Jacob as hin own, and Israel as hin special property. 5. I know sey Baba-God na ogbonge, and he high pass everi gods. 6. Baba-God dey do anytin wey he like, for inside heaven and for earth, for inside di big-rivers and for all deep places [under-under everi big-big-river]. 7. He make cloud rise from where di earth end; he send lightning for di rain, and he bring heavy-breeze from where…

  • Psalm Chapter 136

    He Dey Sorry-forPesin Forever 2. Give tanks to di God of gods—becos he dey sorry-for pesin forever. 3. Give tanks to di Oga of Oga—becos he dey sorry-for pesin forever. 4. Give tanks to Baba-God, na only am fit do ogbonge tins—becos he dey sorry-for pesin forever. 5. Give tanks to Baba-God wey make di heavens wit hin sense—he dey sorry-for pesin forever. 6. Give tanks to Baba-God wey make di earth on top of water—becos he dey sorry-for pesin forever. 7. Give tanks to Baba-God wey make ogbonge lights—becos he dey sorry-for pesin forever. 8. Di sun go rule di day—becos he dey sorry-for pesin forever. 9. Di moon…