Blog

Your blog category

  • Ecclesiastes Chapter 2

    Di Vanity of Flexing Di End of Wise man and Mumu Man 12. So I turn, con reason wisdom, mumu tins, and madness, I con ask, “Wetin di next king wan do wey go pass wetin I don already do?” 13. Naso I see sey wisdom pass mumu, as light take pass darkness well-well. 14. Wise man eyes dey for hin head, but mumu pipo dey waka inside darkness; but I notice sey both wise and mumu pipo dey end in di same way. 15. I con reason for inside my heart sey, ‘Wetin dey happun to mumu pipo nahin dey happun to me sef. So why I con wise?…

  • Ecclesiastes Chapter 3

    Time Dey For Everitin Injustice of Life 16. But I notice sometin wey dey happun under di sun; I see sey wickedness dey for where justice suppose dey, and I see sey evil dey for di place where goodness suppose dey. (Evil for inside court). 17. I con tok for inside my heart sey, ‘Baba-God go judge both good and bad pipo; becos time dey for everitin wey dey happun and for everi work. 18. I still reason for inside my heart about di condition of human being. Baba-God dey test dem so dat dem go fit see sey demsef be like animals. 19. Las-las, na wetin go happun to…