Blog

Your blog category

  • Ecclesiastes Chapter 12

    Remember Baba-God Wey Make You—Wen You Still Young Di Fear Of Baba-God Na Di Koko 9. Evensef, becos di preacher na wise man, he still teach di pipo tins. Yes, he give beta reasoning, he listen to plenty proverbs, and he arrange plenty proverbs. 10. Di teacher calm down to fyne beta words, and wetin he write na di correct tins plus di truth. 11. Di words of wise man be like sharp stick wey farmer dey use take make animal move, and  di words of pesin wey know-book—be like nails wey dem hammer well-well. Dem be from Baba-God wey be di One shepherd of all. 12. My pikin, I…

  • Songs of Solomon Chapter 1

    Di Woman Tok About Her Love Di Padi (Friends) 4. Carry me follow body, we go run follow you, di king don carry me enta inside hin rooms, we go dey happy con dey flex wit you, we go remember your love pass wine, pipo wey get clean-heart love you. 5. I be black, but I fine well-well, oh babes of Jerusalem—like di dark tent of Kedar, and like Solomon curtains. Di Woman 6. No look be becos I be black, becos di sun don shine on me, my mama pikins bin dey vex for me, dem sey na me go dey take care of dia grape-farms, but I no…