Blog

Your blog category

  • Song of Solomon Chapter 2

               Di Woman Solomon 2. As lily flower be among shuuku-shuuku, naso my love be among di daughters. Di Woman 3. As apple tree be among di trees for inside forest, naso my love be among di sons. I sidon under hin shadow as my body dey sweet me, and hin fruit taste sweet to me. 4. He carry me enta di house of party, and hin flag wey dey protect me—na love. 5. Feed me wit dry-gapes, give apples to ginger me, becos love don make me kolo. 6. Hin left hand dey under my head and hin right hand dey hug me. 7. Swear to me, oh daughters…

  • Songs of Solomon Chapter 3

    Di Woman Dream Solomon Wedding Day 6. Who be dat wey dey come from di desert like pillars of smoke, wey dey put perfume of myrrh plus frankincense, wit all di powders wey dey scent—wey market-pipo dey sell? 7. Yes, na Solomon wey dem carry wit hin king-chair. Sixty strong men from among Isreal stand round am. 8. All of dem dey carry sword becos dem sabi fight war well-well, everi man get hin sword for hin lap becos of fear for night. 9. King Solomon, use wood of Lebanon take make horse-moto for hinsef. 10. He make di pillars wit silver, di bottom na wit gold, wetin dem take…