Blog

Your blog category

  • Songs of Solomon Chapter 8

    She Dey Fyne Her Love Di Padi (Friends) 5. Who be dis wey dey waka come from di desert, wey dey rest on her love body?   Woman 6. Na for under di apple tree I wake you [I wake you for my love]; Na there your mama born you; na for there she bring you out from her belle, and she born you. Solomon 7. Put me like seal for your heart, like seal for your hand, becos love strong like death; jealousy hard like grave. Love dey flash like faya—like faya wey dey shine well-well. 8. Many water no fit quench love, and plenty-water no fit carry am…

  • Isaiah Chapter 1

    Judah Turn Against Baba-God Offering Wey No Get Meaning 10. Hear Baba-God word, una wey be rulers of Sodom, listen to di law of awa God una wey be di pipo of Gomorrah. 11. Baba-God tok sey, ‘Wetin be di meaning of una plenty sacrifice to me? I don belleful wit  burnt offering of rams, and di big fat malu, and blood of malu no dey make body sweet me, or blood of lambs or blood of goats. 12. Who dey ask una to bring all dis tins wen una dey come worship me? Who dey ask una to parade for my house wit all dis ceremony? 13. Make una…